Ayomide Raji

Biography: Raji Ayomide Olaitan, known as King of Rhymes, is a Nigerian poet, spoken word artist, author, animator, and certified drone pilot. He grew up in the jungle city known as ajegunle. He is the Founder/CEO of King of Rhymes Poetry Hub and TechRise Coding Hub, platforms dedicated to empowering young creatives and training youths in digital and tech skills. He serves as the Global Teenage Tribe Leader of the African Writers Tribe, where he mentors and inspires young writers across Africa. His work blends poetry, storytelling, animation, and digital creativity to deliver powerful, emotional, and visually engaging art. King of Rhymes is a voice, a movement, and a rising force in African creativity. Subscribe. Listen. Feel. Rise.

Ayomide Raji's Profile


Ayomide Raji
Monday 8 December 2025

Oga at the Top

Oga at the top,
How your chair dey hot?
You dey sit dey chop, dey laugh, dey play,
While we dey run for bus, run for job, run for life.

We dey pay tax wey no show face,
We dey queue for hospital wey no get drug,
We dey watch children suffer for school wey no get chair,
You dey shine for IG story,
You dey claim say everything dey under control.

Oga at the top,
Your mansion big, your car plenty,
But your people dey beg, dey cry, dey shout.
We dey sweat for your comfort,
We dey bleed for your luxury.

Oga, one day,
When rain fall, no umbrella go protect you,
When hunger knock, no money go save you,
When people rise,
No army fit stop the voice of pain.


0
10 Views

Trending Now


Most Rated Poems


Recently Joined


FPG Feeds



>